University of Calabar suspend dean faculty of law ova alleged sexual abuse


 Di Danagement of University of Calabar (UNICAL) don suspend and ban di dean of faculty of law, Professor Cyril Ndifon from di campus ova allege sexual abuse against undergraduates for di institution.


Di institution direct di dean make im handover all im property as di suspension go take effect on 17 August, 2023.


Following di public outcry for social media ova di protest of undergraduates for di faculty of law as dem gada for Monday to express dia displeasure on di sexual harassment wey di dean of di faculty dey do.


Di protesting students – mostly female carry placards wey dem write different tins on top, “Enough of law school list manipulation”, faculty of law no be “brothel”.


But di dean of di faculty of law, University of Calabar, Professor Cyril Ndifon deny di allegations against am.


Comments